[Lyrics] Blue Boy – Lord Abeg Lyrics

London
O lord, man don try watin sup
Hustle don tey shey you dey look face take dey bless
Reason me I don tey for waff
No want be like this next year
Cos if burst luga fit join
But God no go let am sup
I want blow I want blow I want blow
Lord I want blow
I need your rain on me
I dey hustle since 010
But still yet money ain’t come
If I share my problem with you
You should be crying for me
Lord I need your rain on me on me
Lord I want blow, give me beat make I kill
I need your grace in my life
Rain on me the boy dey vex
Want dey enter some kind places
Want dey ball with big big men’s
Who block my way I cut he neck
Give am he tounge chop am like beaf
Every day na he man dey press
Steady hustling dey my head
I need Igbo to clear my brain
Lord you can see we need your rain
Area to the fvcking world
Leave them guy make them go die
Who talk say we no go blow
Talk am reach here your mind go dey
Steady hustling every day
You think say clear mind dey pay
If you get e sure for you
If you no get na you Sabi
Ogbeni no dey brag Put
We know how una reach
I need Igbo to clear my brain
Lord you can see we need your rain
I need your rain on me
I dey hustle since 010
But still yet money ain’t come
If I share my problem with you
Should be crying for me (for me)
Lord I need your rain on me on me
Am a street boy I don tey for junction
God I need your grace Lord
F*ck you men’s way they see the boy dey blow Kpon
God I need your grace Lord
Ama strong like elephant
Story start from 2010
I dey face my fears dey come
Nobody just want help me out
Writing story up on the beat check me out start from the street
I start when am primary 2
Family no get I dey face my fears
Mama dey one side dey pray
Lord have mercy upon your child
All my mate don go remain me
Jipo self don ja last week
Oh Lord why my own dey hard
I offend you I no be Jews
Lord have mercy now
Man don try every day na he man grind
Money go come Money no gree come
Lord abeg, Family Dey wait (Dey wait)
Mama Dey oneside, turn cleaner of tears
Everyway don hot, man dey try to plead hard God
God abeg, lord have mercy now
Man dey grind, money go come
Money no gree come
Lord abeg, lord abeg, lord abeg me I won blow
Oh lord

Click to Comment

Leave a Reply

.

Designed by Admalic Inc.  BMB © 2024.

I need help with…