[Lyrics] Ajebo Hustlers – You Go Know Lyrics

Lyrics
Avantë
If you no use your head
Them go use am drink garri, drink garri o
You no hustle for the bread
For this life you go drink garri, drink garri o
I no need your help
Make you no use my name gist where them dey drink palmy o
I believe in myself
All your doubt e don okpari okpari o
Oh you no know? Now you go know
Sheybi you never know? Na today you go know
Oh you no know? Now you go know
Incase you never know
Na today you go know
Kpos!
Abeggi leave me sef (Abeg)
See I dey find money omo i mean business (omo)
I no dey like something wey go dey give me stress (at all)
Or dey around people wey go dey see me less or like an infidel
Ogini si eba puo (ogini)
Ajebo Hustlers untill the day I fall
As I dey grind everyday me I still dey praise my God
I dey win so dey no fit delay to pick my calls
Abobbi if at all
If you no use your head
Them go use am drink garri, drink garri o
You no hustle for the bread
For this life you go drink garri, drink garri o
I no need your help (I no need am)
Make you no use my name gist where them dey drink palmy o
I believe in myself
All your doubt e don okpari okpari oo
Oh you no know? Now you go know
Sheybi you never know? Na today you go know
Oh you no know? Now you go know
Incase you never know
Na today you go know
I no go fit let you to chop my eye
Abegi make you leave that one you talk na lie
The person wey you fit to dey call your guy
Fit be the reason water comot your eye
I no go fit let you to chop my eye
Abeggi make you leave that one you talk na lie
The person wey you fit to dey call your guy
Fit be the reason water comot your eye
Oh you no know? Now you go know
Sheybi you never know? Na today you go know
Oh you no know? Now you go know
Incase you never know
Na today you go know

Click to Comment

Leave a Reply

.

Designed by Admalic Inc.  BMB © 2024.

I need help with…