[Lyrics] Brymo – Illusions Lyrics

Lyrics
You carry boyi go yonder
You say he no go oh
Slavers boku round town
Hin brother tell am oh
Stand for your ground
Make you no hurry follow go
Them dey sell people troway
My brother no go oh
The people them wey go river never return oh
Dem say na mami water
Carry everybody go oh
For full moon, Papa go farm he never return oh
Them say na the forest carry am swallow oh
Listen boyi, life no balance at all oh
You go place you no know
You no go return oh
Boyi feeling true
Him heart dey beat for the road oh
Him fate na to follow dem
Follow journey go
Ah ah ah
Wetin I think I become ah
Ah ah ah
Na illusion dem dey sell you so
Boyi look forth, him look out
No other place to go oh
He carry him few belongings
Reluctantly follow go
For this life we dey
The things you do you know oh
E better to go reach the place find how e dey oh
I talk am, I shout am boyi still dey travel go
Na destiny dey push man where him dey go ah
He try am, he fight am
Urge stronge no be small
The tori e dey the place
Where him dey go ah
Ah ah ahhhh
Na wetin I think I become
Ah ah ahhhh
Na illusion dem dey promise you so
Oga master no wan know how
Value pig fat pass people oh
He say dem be property
With him dog dem equal oh
Boyi clean gun, he shave beard
Oga trust no other
He for adopt boyi, but him people hala
That night boyi take razor he shave am proper
The way Oga dey like am, no touch him moustache ah
Poison for soup, for family and the guards dem
He slash master throat too from ear to ear ah
Ah ah ahhhh
Boyi na most wanted for strange country ah
Ah ah ah
He dey gather soldiers ah
From plantations he dey break boys free
Ehn ehn
My people
The main reason we gather here today
Na him concern us now
Na there we dey go next
Ah today on behalf of the people of the city and the township
The entire tribe and our very very race
We go unveil this statue of boyi
We go give our honorable personality himself
The scissors to use cut the ribbon
For service to humanity
And to race and eh we salute you sir
We salute you well well
Because you really touch our lives
You don change our lives
From generation to generation to come
Nothing go ever remain the same for us
Yes, this statue na the honor of your greatness and service
Thank you

Click to Comment

Leave a Reply

.

Designed by Admalic Inc.  BMB © 2024.

I need help with…