[Lyrics] Burna Boy – “20 10 20” Lyrics

Lyrics
Shey you never hear
About the things wey happen there
Abi your eye never clear
Mankind so wicked
Let’s talk about my government
Open your mind and your ears
Wetin happen
Shey na jazz o
Make my people suffer suffer
All their nyanshes don dey open
Everything don scatter scatter
Twentieth of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so water o, water runaway my eye
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder
The Chief of Staff, the commander
And the army wey carry order
Mr. President, Mr. Governor
Godfather, gbo gbo ijoba
All your atrocities
All of your corner corner
Make all the deadbody disturb you for your dreams
The money wey you thief yapa for your azza
You don turn our graduates to common beggars
All the book them go no matter
‘Cause you no go get job if you no know Godfather
The Chief of Staff, the commander
And the army wey carry order
Mr. President, Mr. Governor
Godfather, gbo gbo ijoba
All your atrocities
All of your corner corner
Make all the deadbody disturb you for your dream
Twentieth of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so water o, water runaway my eye
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder
We give them many chances
Dem fail my people
And When we cry for justice
Them kill my people
Walahi all of you
Their lives are on you
We no go ever forget all the youths
Wey die for tollgate
Ahh, ay, ahh, ay, water runaway my eye
Ahh, ay, ahh, ay, water runaway my eye
No problem, no problem
Everyone stay down, stay down, stay down
(Let the boy, let the boy get off the light)
How this one survived, other people, ah, they’d be shot and killed
Twentieth of October 2020

Click to Comment

Leave a Reply

.

Designed by Admalic Inc.  BMB © 2024.

I need help with…