[Lyrics] Erigga – Ballads Of A Lost Boy (Word Poetry) Lyrics

Lyrics
My name na erigga
For those wey just enter my school of thought
The things we thought before motivation we’ve been on top
But I’m still lost
Lost in my thought, finding fault, is it mine? Is it yours?
Funny thought
Before the story drop why don’t we take some shots
Warri crisis 1997 enter 1999 really shape my thinking
Lost a lot of my bros and sists in a blinking
Forget the oil for ground, I refine the one for my head
Made money but I’m still lost
Part of me is still lost
Toast to the thinking “entitlement go make us rich”
People switch like fake nyansh and real nyansh
It’s hard to tell which is which
Lost in the women and the drinking, smoking and hoping
That one day my government go serve me
Dem no tell me before I switch to investing in myself
Empty my savings
1999 for Okumagba Avenue, Nine Erieovo
Deepest part of the ghetto, darkest, everyone know
Africa wake e dey happen
People dey hear the voice now e dey happen
Breeze go blow small-small politicians nyansh go open show
Fowl dey beat ole fowl, e dey happen
Sleeping sons of Jacob, wake up, e dey happen
Every day for the thief but one dey for who catch am, e dey happen
Erigga too good, God, make dem dash am
With all the things he’s been through, nothing scratch am
When God say na your time na your time
No matter the continent you find yourself or anywhere you dey
Na still your time, ’cause na the same time
But at the same time, we dey grind
I know people when tell me say my album go flop
Fast-forward, them shock to see am they pop
I rather dey on top chart than on top your girl
Money na the only friend we fit rely on well
Na me be that basket way dem de use fetch water
Just to disgrace bucket, stop playing with me
If you dey go through a lot, my brother go come, stop playing with me
We have all been through there, no use sub me, disturb me
Na beggie-biggie make you feel say your brother stingy
Entitlement na disease enter pharmacy
For am to pain I gats talk am for pidgin
Nobody owe you chi-chi so brother, namaste
2016 I dey cell dey think my life
Dey write for wall I swear I almost mentos
For matter way no concern me, naso them find me
Handcuff me like arm robber when dey pem tools
That was then I no sure say e fit happen again
I’m wiser now money dey I can’t complain
Never to catch falling knife leave them make dem talk
Na Ribena una be, we no be God
We no be blood
A king and a slave for it is both our duties to serve others
Ballads of a lost boy
The movement just dey start
Una go soon dey take orders
Abeg

Click to Comment

Leave a Reply

.

Designed by Admalic Inc.  BMB © 2024.

I need help with…