[Lyrics] M.I Abaga – Plan B Lyrics

Lyrics

If I get presido wey love me
Shey na so everything go ugly
No be say I dey try insult him
But trust me, things are rough in the country
If I get presido wey sabi, shey na so general go steal from army, take money for weapon
give him family, him soldiers still dey die, what a tragedy
(On God)
Presido wey full ground, and him hear say na young people dem dey shoot down
IGP go dey him office still dey kneel down
Him go tell him boys make dem cool down
Presido wey care for the future
Better road for everywhere go too sure
Pursue minister wey no do good job
Cos all these politicians dem dey too chop
I swear everywhere country don tough
Once I get my papers I’m off
Once I enter jand I don lost
Make Naija just give me divorce, I swear
Go market, everything cost
On top your degree, you no go find job
Government sef dem no respect us
Dis Naija e no be by force I swear
If I get governor wey honest
Wey dey try to keep all of him promises
Wey no go use the people to be come rich
Wey go use him eye to see the condition
Maybe him go see the insecurity
Kidnapping everywhere in every big city
Terrorist dey do so much atrocity
Governor wey send e go dey the issue
Governor wey sabi, shey e no go go the university
Students dey suffer just to get degree
Without education my people cannot reach there o
Streets are bloody, all the senators dey disappoint me
Una wey dey run shit, we are purging
And that’s the situation in my country yeah
I swear my people, everywhere rough
Once I get visa I don cut
Get new phone for there, I don port
Make Naija no vex e too much
See yankee everywhere soft
Make I go hustle wetin mail go take chop
Die for this country, that na bad luck
Dis Naija e no be by force, I swear
If pastor dey wey dey fear God
Wey love him people like him love him hair cut
Him go sell the jet wey dey the airport
Cos plenty people dey wey need him support
If pastor dey wey dey talk true
Shey na Wetin we go see inside the court room o
Shebi anointed one nothing fit touch you
Na why your prophecy e no Dey come true again
Professor wey wan make we stand out
E no go take money to give us handout o
E no go drag that girl inside him compound
The things I Dey see e dey dumbfound me
E be like say everything dey scatter
I don tire for the matter kpata kpata
I just dey pray make I gather my raba make I japa to another country and ooo eeehhh
Yankee you boy Dey come

Click to Comment

Leave a Reply

.

Designed by Admalic Inc.  BMB © 2024.

I need help with…