[Lyrics] Abobi Jammaker – Love & Money Lyrics

E get this girl I fall inlove with
Anywhere I Dey na she be my gossip
Many promises I think say she Dey love me
For this business na she wey be my profit
Fine boy but her friend say I ugly
She no Dey kiss me
she even no dey hug me
We Dey for bed and she even no Dey touch me
E be like contract na she wey dey endorse me
Because I never get money
Gf I get don Dey follow form for me
I wan Kill myself she go borrow gun for me
Heartbreak Aboy e be like follow come for me
I Dey love girls but them no Dey love back
20 missed calls but them no Dey call back
Take me for a fool because
I Dey love mad
Na dem go complain to say I Dey love Razz o
I say LOVE o
(No be money wey you get No be money wey you get)
I say LOVE o
(No be body wey you get o No be money wey you get)
You can be inlove with a broke man
You can be inlove with an old man
Say you can be loving me
And I’ll be loving you
Inna d rain n the sun never hurting you yeah
I say my girl no Dey send me
Her friend Dey curse me and she no defend me
Make I find work begin buy her fendi
I Dey bite her for belle like appendix
And I cannot believe her
Na she Dey drown and na me wey be her river
I give her kidney
I wan Dey give her liver
I give her school fees
I try just to feed her
Because I never get money
Girlfriend I get don Dey follow form for me
I wan Kill myself she go borrow gun for me
Heartbreak Aboy e be like follow come for me
I Dey love girls but them no Dey love back
20 missed calls but them no Dey call back
Take me for a fool because I Dey love mad
Na dem go complain to say I Dey love Razz o
I say LOVE o
(No be money wey you get No be money wey you get)
I say LOVE o
(No be body wey you get o No be money wey you get)
You can be inlove with a broke man
You can be inlove with an old man
Say you can be loving me
And I’ll be loving you
Inna d rain n the sun never hurting you yeah

Click to Comment

Leave a Reply

.

Designed by Admalic Inc.  BMB © 2024.

I need help with…